₿ITCOIN PIDGIN (@Bitcoin_Pidgin) header
₿ITCOIN PIDGIN (@Bitcoin_Pidgin) profile picture

We dey use Pidgin teach #Bitcoin because say we gats dey use our language break down #Bitcoin so dat e go dey easy for everybody to grab.

Naija
Joined January 2023
Photo by ₿ITCOIN PIDGIN (@Bitcoin_Pidgin)Photo by ₿ITCOIN PIDGIN (@Bitcoin_Pidgin)Photo by ₿ITCOIN PIDGIN (@Bitcoin_Pidgin)Photo by ₿ITCOIN PIDGIN (@Bitcoin_Pidgin)Photo by ₿ITCOIN PIDGIN (@Bitcoin_Pidgin)Photo by ₿ITCOIN PIDGIN (@Bitcoin_Pidgin)Photo by ₿ITCOIN PIDGIN (@Bitcoin_Pidgin)Photo by ₿ITCOIN PIDGIN (@Bitcoin_Pidgin)Photo by ₿ITCOIN PIDGIN (@Bitcoin_Pidgin)Photo by ₿ITCOIN PIDGIN (@Bitcoin_Pidgin)
Set a reminder for our Space with @thecoachayobami (E.D of @BitKwaofficial), @malkrite (Founder of @citrusrate), and awa own oga @kesterbils. Set reminder make you join us hear how awa waka from Naija to Ouagadougou. teapaw.org/i/spaces/1qGvvknBEblGB

3
10
311
You wan complain about Bitcoin? Who you go call? 😂 “Hello, Bitcoin CEO?” “Abeg, my transaction never enter.” “Abeg, reduce Bitcoin price make I buy.” “Abeg, increase Bitcoin supply.” 😂 No CEO dey there. Bitcoin no be company wey one person dey run.
1
20
The network get rules, and plenty people around the world dey verify those rules independently. Nobody get the big red button wey dem fit press to control everything. Na one of the things wey make Bitcoin different. #BitcoinPidgin #Bitcoin #BTC #BitcoinEducation
1
13
Today we dey put the spotlight for one outstanding bitcoiner, Kester Ejikeme. @kesterbils Oga Kester, na the Oga of @BitcoinAnambra & @Bitcoin_Pidgin wey dey help many people to sabi wetin dey sup for the Bitcoin Ecosystem. Thank you for the light wey you dey shine. Twale!
2
3
71
₿ITCOIN PIDGIN retweeted
It's happening! We are set to host a Physical Bitcoin Bootcamp in collaboration with @TrezorAcademy More information dropping soon but secure your seats immediately using this link: bit.ly/BitcoinBootcampAwka
3
3
1
16
334
Today we dey put the spotlight for one outstanding bitcoiner, Theophilus Isah. @Extheo Oga Theo, na the CEO of Mavapay wey don help many people with cross border payments for the Bitcoin Ecosystem. Na because of people like am we fit talk say some kyn things dey possible!
4
5
117
Imagine say one person dey control all the banks for the world. Anything wey e say, everybody must follow. Now imagine say instead of one person to control everything, thousands of people get power to control wetin dey happen. Na small way to understand decentralisation.
1
1
1
41
For Bitcoin, people around the world dey run nodes to verify transactions & check whether e follow the network rules. So Bitcoin no get one central place wey everything dey pass through. Control no dey one hand. Na decentralisation be that. #BitcoinPidgin #Bitcoin #BTC
15
Why Nigerians like Bitcoin? Ask five Nigerians and you fit hear five different answers. One go talk investment. Another person go talk say: “I just wan understand this Bitcoin thing.” Another person fit dey interested because of international payments.
1
1
1
52
Another person fit just like the technology. Another one fit talk say: “Na My guy introduce me.” Regardless of the reason, one thing don dey clear: Bitcoin don become part of the financial conversation for Nigeria.
1
17
So tell us, wetin first make YOU dey interested for Bitcoin? #BitcoinPidgin #BitcoinNigeria #Bitcoin #BTC
7
₿ITCOIN PIDGIN retweeted
Anambra’s Bitcoin community is on the continent map. Kester Ebuka Ejikeme @kesterbils, Founder of Bitcoin Anambra @BitcoinAnambra, BitDev Anambra @BitdevAnambra, and Bitcoin Pidgin @Bitcoin_Pidgin, has been named in the Africa Bitcoin Conference's @AfroBitcoinOrg Starting XI.
1
3
20
319
Everywhere you go, person dey boss people. Office get oga. Bank get MD. Company get CEO. Even WhatsApp family group get one aunty wey dey control everything. But Bitcoin? Who be the oga? Bitcoin no get CEO wey fit wake up one morning change everything.
1
1
2
72
People dey run nodes, miners dey process transactions, developers dey work on the software and users dey participate for the network. Everybody dey work with the rules. No single person get the whole remote. #BitcoinPidgin #Bitcoin #BTC #Decentralisation
29
Imagine say you get ₦500k. You give your friend make e keep am for you. Who get the money? You. Who dey hold am? Your friend. Na small way to understand custody. For Bitcoin, custody na simply who dey hold and who dey control the keys to your Bitcoin.
1
1
45
If another person or company dey hold the keys, dem dey control the custody. If na you hold your own keys, na you dey control your Bitcoin. So when Bitcoin people talk say: “Not your keys, not your coins.” Now you know wetin dem mean. #BitcoinPidgin #Bitcoin #BTC #Custody
20
Our Oga go dey here today. Make una join in!!!! Insights go plenty like water!
Join me tomorrow as I'll be joining @BitcoinEkiti space to discuss Circular Economies and drop insights on how to convince a merchant to accept Bitcoin as MoE.
3
3
68
You get that friend wey no dey forget anything? 😂 You fit tell am something today. Three years later: “But you talk say…” Na that kind memory blockchain get. Bitcoin blockchain dey record of transactions that happen on the network.
1
1
53
Once transaction enter the blockchain, e become part of the permanent history of Bitcoin. You fit go check am. You fit see when transaction happen. You fit see the Bitcoin addresses involved. Blockchain no dey gossip. E dey record. #BitcoinPidgin #Bitcoin #BTC #Blockchain
1
22
Imagine say person wan send you ₦1M today. How you for like make dem send am give you? CASH, WESTERN UNION or BITCOIN? #Bitcoin #BitcoinEducation #BitcoinETF
3
59
Money fit lose purchasing power as time dey go. But Bitcoin no dey come with expiry date. The important thing na to understand wetin you hold, why you hold am and how you fit keep am safe. #BitcoinPidgin #Bitcoin #BTC
2
4
95